Tuesday, February 17, 2015

Baba Iyabo tear im card! So what?!

So as e tear im card how e dey take affect us? D tearing go bring back our girls? D card tearing go make Nigerians begin enjoy all the things wey dem don dey promise us since 1999?

As e tear card my house rent don reduce, abi I don begin enjoy light? All those money wey we dey hear say some people no know wetin dem wan take am do go go the right places?

Abi dem no know say Nigerians know d things wey APC and PDP dey do?

All of una fit swear before my forefathers shrine wey never c blood for decades say una no know who burst gas pipeline wey dey supply gas to THREE power plants?

Yes! Dem burst am in d name of politics. Begin punish masses wey no get mouth.

Who tell am say card tearing go wake up Jona? If na so, millions of Nigerians for don tear their report card, hospital card, (national, work, personal and unpersonal) ID cards, shitting card, pissing card, farting card! ANY CARD!

We don shout and write Jona; visit am for dream, send ancestors to am, give am nightmares so tey we give up! E no hear. Na card tearing go prick am!

Una take one mouth dey ask for change and use same dey ask for continuity. Which one we go follow?

Nigerians no send all of una again. Na jobless people, wey call themselves politicians, go take card tearing important.

Every time one of the old guards open that laughable imitation of a mouth to talk, we no dey hear again. It is called selective deafness. We learnt from you politicians, who are perpetually afflicted with a disease called selective amnesia!

It is like when P-Square were on the verge of breaking! What they do not realise is that to millions of Nigerians, it is unimportant who sings or dances. Just make us happy! IS THAT TOO MUCH TO ASK?

THAT CARD TEARING IS LIKE THE SOUTH END OF A HORSE!

No comments:

Post a Comment

Have your say